Nigerian Football League

Nigerian footballers. This league eeh no be small one ooh. This guys dey ball wetin no good. That guy for front wen dey hold the flag. eh! That guy too play ooh. You for like see how him just cut the first guy, comot the second guy for road just dey cut people destiny dey go until him come reach the last man, that guy self no hold ground na so him cut am again him lick grass. When match come end dey ask the guy wen lick sand say if he be enjoy am. Him come talk say Nigerian grass dey sweet normally but as them cut am so the force wen him take reach ground no really allow am enjoy the grass wen him dey chop. I pity the guy sha. But we move on.

Bring on the next news we Nigerian football association dey really enjoy this sports.

Another picture for una make una know say na enjoyment we come do for here